Mother Allegedly Dumps her Child on the Road After her Pastor Told her she’s a Snake
A woman identified as Amara Emeka dumped her little baby girl by the roadside in Sapele, Delta state, on Sunday after being told by a pastor, Apostle Paul Andrews of God’s Rhema Assembly that her baby was a snake and he needed N52,000 to conduct a deliverance on her.
According to a Facebook user, Sapele Oghenek who shared the photos, the baby was found in Green Egbedi by Reclamation Road, Sapele, on Sunday morning, around 4:30 a.m and was taken to a police station by residents. Hours later, the mother of the child was located and brought to the station to identify her.
At the police station, the mother reportedly said she abandoned her child because she did not have the N52,000 requested by the pastor to cast out the demon.
Below is how Sapele reported the incident.
If I talk about men of God, some persons here go carry cutlass for my neck,like say na all men of God, nai God call.
Make I nack unu this very short story make only unu tell me who dey wrong before I go use am do post by 3pm about wetin I think about this people wey involve.
We all know say na women nai go Church pass and na dem nai still dominate marine world and coven. Where problem nor dey,only some women go use deir legs go find trouble put,after them go dey catch witch.
Yesterday early morning at about 4:30am for “Green Egbedi by Reclamation road”,nai dem see one baby for d junction dey cry seriously. As God go do am,dem cum carry the pikin go Police Station,go register the case and make complain.
Na later in the day,dem cum see d mother of the baby,wey cum talk say,na one pastor wey get Church for cemetery by palace hotel,nai tell her say,her pikin na snake and make she bring N52,000. So that he fit pray for the baby and d baby go dey better.
The name of the woman na Amara Emeka and she dey stay macphason by Komi Rd. Na the Pastor talk, nai put fear for her mind, wey make her go drop the woman for the junction,so that the baby go cry die or make dem carry the baby go Madam Buwa easily, becos she nor fit raise the N52,000 to give her man of God.Make we all nor look this matter throway face, becos e good make we pour out our mind,for others to learn from.
According to Tafia Keneri,e say some Pastors dey use bottom power take dey talk with deir members and e dey make the members dey fall victim to anything dem tell them. Keneri say na charm some Pastors dey use.Marian Jasper talk say, she nor believe the woman, say she dey lie and also talk say,if she nor want the pikin,why she nor throway her for other places,wey e be say,na where eyes go quick see d baby and na make dem for pity her,make her go dump d baby there.
We for studio don think this matter pass different angle,nai make we say make we hear unu version.
Photo credit: Facebook
Na wa oh. The gullibility of Nigerians is alarming smh. The way we take this religion thing ehn Hmmmmmmmm.
Ignorant is a big disease ……Fake pastor everywhere